Sunday 2 June 2013

Jokes in Pidgin English (47) – Night Party; Nigeria’s ban on ‘homo’ (gays)!


See, na joke o. E get one guy when dey like night party. Lots of drinking, dancing with poor lighting! One day, the guy go one party. As usual, he was dancing, singing, drinking, etcetera etcetera (I like this grammar). After a while, he noticed another guy was dancing too close for comfort. Na so my guy tell the other guy,
‘O boy, I nor be babe, I be guy o.’ (Thinking the guy was too drunk not to notice)
The other guy reply,
‘I know.’
My guy say,
‘You know wetin?’
The guy answered,
‘I know say you be guy. Me, I dey like guys.’
My guy hala,
‘Shuooooooooo! Kweke ooooo (no English version but na exclamation remarks)! Ogheneme (My God)!’
 My guy run reach house. My guy come dey reason,
‘This one wan Nigeria Congress abi na Parliament don ban ‘homo’ (gays) with the punishment of 14 years imprisonment, anybody wen use mistake go dance anyhow, dem come suspect say na ‘homo’, na prison be dat. Hmmm… na waooo. Me, I nor go that kind night party again ooo… ‘

That was the last time my guy go night party. O man, abi na O people, na joke oooooooooooooooooooooo. I nor dey there oooooooooooooooo.....

No comments: