Monday 8 April 2013

Jokes in Pidgin English (42) – Ajebu and Kpako in Labour!




If you see two women in labour, you can tell who be Ajebu (grew up in a privileged home) or Kpako (grew up in a less privileged home) by the things they say when they in pains.

You see Ajebu grow up in a rich well-to-do home. When she dey small, if you beat Ajebu, she go cry, ‘Mummy! Daddy!’ Everything na, ‘I’ll tell my mum and daddy.’ So, when Ajebu don grow up, marry and get belle (pregnancy), wetin she do for small pikin level, na so she go continue as adult. When Ajebu dey labour, she go shout: ‘Mummy! Mummy! Honey! Honey! Darling, where are you? I’m in pains.’

But if Kpako dey labour, the story must change. You know say Kpako don suffer before. When she dey small, if you beat am, she go curse you, ‘Your Papa! Your Mama. You dey craze! Na my body you dey get power! Go beat you mate, ode!’ That is why when Kpako woman grow up, marry, get belle and come dey labour, she go dey insult the husband and all and sundry: ‘Johnbull, where you dey? Johnbull, with your big head, where you dey? Na you put me for this one o. Na you put me for this wahala. Johnbull, e nor go better for you ooo… John… bull ooo… Nurse, where you dey with your white garment. The thing dey pain me ooo…’

No comments: