Wednesday 23 January 2013

Jokes in Pidgin English (21)! – Deaf and Dumb!



This time na bad time to be deaf and dumb o. e get one guy wen dey form deaf and dumb. Every day this guy go stand near one govt building dey beg with big sign for em chest: DEAF AND DUMB! HELP! e come get 2 Warri boys wen dey always pass there go work. Everyday them dey see the deaf guy. The Warri boys come dey argue:
‘That guy na fake deaf and dumb.’
‘Na lie, how big guy like that go dey form.’
‘I dey tell you, that guy na wayo e dey do, if na lie make we go test the guy.’
Na so these Warri boys plan how them go deceive the guy.
One evening as dem dey come back from work, dem come hold five five naira wen dem go give d deaf guy. As dem dey drop d money, dem come dey talk small small among themselves.
Warri 1: Na wow. Na bad thing to be deaf and dumb.
Warri 2: Na true. That’s why dis guy never hear say dem throw bomb for the next street now now.
Warri 1: I even hear say this govt house here na the next target o.
Warri 2: Abeg make we drop dis money make we kawai, make dem nor turn us and dis guy to burnt offering o.
As d Warri boys turn their back dey waka go, after few seconds dem turn back see deaf and dumb don tear race dey run from d govt building. O boy, na im burst laugh o.

No comments: