Tuesday 28 May 2013

Jokes in Pidgin English (46) – Some kind questions self???


E get questions wen dey make me vex. E.g.
1.  When you reach your working place, your co-worker go ask you,
‘You don come work?’
Na which kind question be that? You see me with tie, you dey ask me whether I don come work? I never come work. I wear the tie for exercise.
2. You dey your house dey chop food, your neighbor come ask you,
‘You dey chop?’
No, I nor dey chop. I dey use food do throat exercise, ‘gbulogbulogbulo…’
3. One day, I sit down outside one evening with my laptop, somebody come waka small small come my back. When I notice say person dey my back, I carry my laptop jump up. I nor know whether na thief. You know the question wen the guy ask me,
‘Are you fearing?’
No, I nor dey fearing. You see me wan run with my laptop, you dey ask me ‘Are you fearing?’ Wait, make I enter my house, lock my door, then you go know if I be fear fear. I go give you slap thru my door.
4. You and person dey house since morning, no food. When you cook finish late afternoon, you come dey ask,
‘You go chop?’
Hmmm… why not ask, ‘You sabi chop? Or, you know how to chop? Or, you get mouth?’ Dem dey teach hungry man eating lessons?
5. You and a lady friend came out of a restaurant. When you both came out, you saw that it was raining heavily. The question the lady asked was,
‘Is the rain heavy?’
O girl, the food when you chop don blind you? Even if you blind, you nor get ears to hear? Haba? The rain is not heavy, the heavy pounding you hear on the roof is made by some musicians up there.
6. Her next question,
‘Will it stop soon?’
Yes, na me be the manufacturer and producer of the rain. Na my Papa dey control the rain. Where I put the remote again?
7. You and the lady friend reach house.  You open door like a gentleman and make every gesture for her to come in, the question she will ask,
‘Can I come in?’
No, stay outside make rain beat you, my friend!
8. When you and your friend enter house, next question,
‘Do you have a room heater?’

Yes, like the type wen dey your Papa house. Why you nor put am for hand-bag carry am follow body, so that the thing go dey blow you heat for road?

No comments: