Wednesday 12 December 2012

Jokes in Pidgin English (2) – You wan fall in Love? (Remix)


Those days for Uniben! E get one guy wen dey go out with one girl, professing undying love, ‘I will die for you’. My guy nor know say the girl original boyfriend na one top cult guy. You know girls wen dey like to keep their options open, in case yanwa gas for one end. When the cult guy hear say one guy don fall in love with em girlfriend, d guy arrange some of em boys make dem go handle d girlfriend lover. Na’em dem hijack lover boy go one corner. Dem give d guy pep talk:

Cult guys: When Adam fall in love with Eve, wetin happen?
Lover guy (confused): Adam commit sin
Cult guys: No, wetin happen to Adam last last?
Lover guy: Adam die.
Cult guys: Good. When Romeo fall in love with Juliet, wetin happen?
Lover guy: Romeo die.
Cult guys: Good. When (name withheld, to avoid stories dat touch) fall in love, wetin happen?
Lover guy: He die.
Cult guys: Good, you wan fall in love?
Lover guy: Nooo, Bros abeg I nor wan fall in love ooo. Abeg!
Cult guys: Good, if you nor wan fall in love, you know dat girl…. Stay away from her.

My people, I wonder wetin my guy go tell d girl d next time dem jam. ‘Baby, you know you are so beautiful. I’m so scared of falling in love with you. You deserve someone better. I don’t deserve you.’ Afraid nor go make my guy yan d truth. In dis case, d truth is not only bitter but deadly.

No comments: