Tuesday 5 March 2013

Jokes in Pidgin English (35) – Why e be say?


Why e be say when you watch Indolmie advert, you go see the cooked Indolmie with fried chicken and boiled eggs in the same plate as if the chicken and the egg come with the Indolmie pack? Wetin dem dey try tell us: you can’t eat Indolmie without? I thot that the purpose of Indolmie is to make sharp sharp meals in minutes. The time you go spend take fry that chicken and boil that egg, you nor go cu coma cook rice or boil spaghetti/macaroni?

Why e be say some of our ladies like too much forming/yanga/dege posing? E get one time when one guy waka jam one lady dey soak garri (drink soaked garri) one early morning (early morn morn). Nor do nor do, instead of the guy to maintain, he ask the lady, ‘Why are you drinking garri this early?’ The lady, instead of her to admit say ground nor level/things hard, she say, ‘I’m watching my weight.’ Uhmm… Watching weight with garri before 7am! Uhmmm… Wetin do Golden Morn and Quaker oats? What about going without or exercising on an empty stomach?

Why be say when patients dey for queue dey wait for their turn to see doctor, them go they complain, ‘This doctor too dey slow,’ but when e reach their turn and dem enter the office  to see doctor, dem nor care whether the doctor dey slow, them go talk from now to Jericho? In fact, if the doctor check them sharp sharp, dem go still complain, ‘that doctor too dey fast; e nor even listen to all my complaints before e begin write.’ Well, as people talk, ‘na another man fit craze.’

No comments: