Monday 1 April 2013

Jokes in Pidgin English (39) – Pregnant Lady, Part 1!



Scene 1: One pregnant lady went to a public place with a see-through outfit. I mean you can see every including baby bump. Just imagine wetin dey go thru the mind of the baby: ‘Mama, na wa for you. You think say you still be omoge abi. When you drop me now, you don turn mama pikin o. Which one be this one na? Why you dey use me do show glass?’


Scene 2: There was this pregnant woman who visits ‘Mama Put’ restaurant all the time. Every day na Mama Put. Imagine wetin dey go thru the mind of the baby: ‘Mama, which one you nor dey! Everyday na Mama Put? Wetin do Mr Biggs, Tantalizer, Chicken Republic, GT Plaza? You think say I nor know better thing? This one wen you dey do me so, hmmm… No wahala, my time dey come. In some months time, my time go come. You go hear am…’


Scene 3: There was this woman who got pregnant for the seventh time. She did not want the pregnancy but the husband insisted on keeping it. Every day, she complains about the pregnancy to everyone who cares to listen: neighbours, relatives, friends, co-workers, health workers etc. she speaks ill of the pregnancy. Imagine wetin dey go thru the mind of that baby: ‘Mama, na me be this? You think say I nor dey hear you abi? You dey yab me follow town abi? Na my fault? Na me cause am? I nor dey there when this thing happen o! As you dey yab me so, no wahala, my time dey come.’

No comments: