Sunday 28 April 2013

Jokes in Pidgin English (44) – University ‘local’ visitor!



My people nor vex o. If the joke concern wetin concern you, abeg na joke I dey o. Nor be quarrel o! E get one guy. He dey one thick village like that. One day, he ma say make e go visit the friend when dey one university for city. As he reach the university, him and em friend come dey stroll. This village guy come see many  students when wear white and black. The guy say:
‘ha, who na still do choir practice for university?’
Friend respond:
‘Nor be choir members o. Dem be law students.’
‘Hmmm… I nor know say dem dey wear uniform for university like primary and secondary school o.’
When dem waka reach front, them see some students when wear white white coats. Village guy hala, ‘These people unko? Na Seraphim and Cherubim church dem ma dey go? Why dem wear white?’
Friend: ‘No, na medical students dem be.’
Nor do nor do, dem waka meet some guys when carry long boards for hand. The guy hala:
‘Ha ha? Who na still dey use slate for university? That na ‘akara’ school level na?’
Em friend come burst laugh. ‘Na wa for u? Those na Engineering students wen dey come back from practicals. Those boards na their drawing boards.’

No comments: