Friday 18 January 2013

A Joke a Day keeps the Doctor away (18-01-13) -3



In Remembrance - UNILAG/MAUL Saga - Part 3

Now wen Unilag don turn to MAU (d sound resemble d sound wen cow, namanama, dey make) and LUTH don turn MAUTH (sounds like mouth), medical students in LUTH and doctors wen finish frm LUTH nor go get MAUTH to talk again.
'Hey u, which teaching hosp did u finish frm?'
'MAUTH' (in whispers)
'Come again, is somethin wrong with ur MOUTH? Speak up!'
'I said MAUTH, Sir!'

Imagine medical student from LUTH dey follow dat from UBTH dey quarrel. Maybe dem jam for NIMSA Games.
LUTH: dat na my space na. Wetin u dey do there?
UBTH: See ur MAUTH. Who give u space here? People dey talk, u still get MAUTH to talk.
LUTH: I nor blame u. If nor be dat man wen resemble ...., go change d name of my sch, u for nor dey talk dis na.
UBTH: MAUTH, keep ur MAUTH shut. If i slap dis ur MAUTH, u go resemble d man wen give una dat name.

Ayaaaaa.... I dey pity for Unilag students and graduates. No more swags and phonetics. Listen:
Guy: Hi, i'm Sam. What's ur name?
Lady: i'm Angela but my friends call me Angie (see fonee)
Sam: I finishd from Uniport. What sch did u finish from?
Angie: (hesitantly) em em eh eh (she go come give d history of her school), actually i finishd from the University of Lagos, Unilag(fonetically) but i learnt the name has bn changed to ....(pretending she's forgotten)
Sam: Oh! U mean MAU?

O girl, na dere swag take end o. Ayaaaa.. I dey follow una dey mourn d death of swag and fonee..

No comments: