Tuesday 15 January 2013

Jokes in Pidgin English (12)




If in your work place, you get three married men when dey work with you, u nor need to ask dem their tribes, na d way dem dey act follow you go know where dem come from.

If na Hausa man, e nor dey receive call from home say ‘wen u dey come house?’ E nor dey rush to go home wen e close from work. E dey take him time. Him fit go anywhere e like, anytime em like e reach house. D excuse wen e dey take, ‘I wan go pray’ ‘I wan go break fast.’ E nor dey fear anything. D wife go dey house jeje, she nor dey comot. She nor dey complain. She know say if she too complain, d man go marry another wife sharp sharp. She nor dey bother wether d man get girlfriend outside, bcos, it’s just a matter of time, another wife go come join or displace her. Her only prayer be say make d man nor bring bad market come house.

If na Yoruba man, na d opposite. D phone dey always ring. ‘Honey, wen are u coming home?’ Dem go talk for 10mins on top of one question. If u get Yoruba co-worker wen don marry, o boy u nor go hear word, ‘please I need to go home to pick something’ ‘please I need to go home, my mother-in-law is around’ ‘please I need to go home, my wife’s uncle’s step sister from village is sick’, na so so excuse. Wen e close, e don reach house sharp sharp. He dey submit daily briefing on all d places wen e go. D wife get visual lie detector wen she dey take pick d man lies, ‘it’s a lie. U went to see ur girlfriend’ she nor dey too fear. Even if d man get girlfriend, em head nor correct to bring d girl come house.

If na Ibo man. E nor wait make em phone ring, na him dey call. ‘Lolo, how now? Papa Emeka don supply d goods?’ As Ibo man dey govt work dey hustle, d wife dey their shop dey hustle too. No time for play or joke. Ibo man dey plan em time. Everything is well calculated in advance. E nor dey take excuse wen nor get monetary value. ‘I’m going to the bank’ ‘I’m going to the warehouse’ ‘I’m going to accounts, my salary last mth was short of 5naira.’ Ibo man wen e close, e go call the wife, ‘Lolo, u still dey shop abi?... em nor worry, I go take d children from sch go house, give dem food b4 u come. Abeg collect dat money from Mama Ify, if she nor give u, nor come house oo.’ Ibo men na their marriage dey last pass, u know why? Any time e reason divorce, e go remember d millions wen e spend take marry d wife, e go cancel d idea. B4 Ibo man divorce, dat means d economic value of been a divorcee will be far greater than staying in d marriage. Unlike his Hausa counterpart, Hausa man dey change wife d way people dey change handset. E nor dey spend too much. Easy come, easy go.

I like all of them, dem dey always make me naff……

No comments: