Saturday 19 January 2013

Jokes in Pidgin English (16)



‘I wanna go!’
Somebody ask me why I dey like to write write online, I tell d guy, “See, guy now is the time to discover other talents ooo. Because the way things dey change for Naija now, make you nor wake up one day, dem say Naija don turn to Jamaica ooo. Because if Naija change to Jamaica, if you nor sabi, ‘what ah guan?’ na wahala ooo.”
This thin come make me remember one staff wen dey work with me those days. She dey assist me dey interpret. Dis lady, uhmmmm! She dey speak Special English. English wen nor be Pidgin English and nor be good English. English wen I never hear for my life before. I dey use sense dey listen so dat she nor go interpret toxic stuff to me or the patient. Any time wen I see say she dey stammer, ‘em eh em eh’ I know say na toxic stuff dey come. So I go rewind wetin I talk. This lady, any time patients don finish, if she wan go house, she go say ‘I wanna go.’ E be like say dat na the English wen she learn from India films.
Na so, every day wen we close, ‘I wanna go’…. ‘I wanna go’
So one day, she wan go collect something outside then she go come back later, she say, ‘I wanna came’
Na so I quickly tell her, ‘before u wanna came, me I wanna go ooo’
Na so I take comot o… It's all good. All join! Enjoy!

No comments: