Wednesday 16 January 2013

Jokes in Pidgin English (13)



Mr Lecturer!
Those days 4 school, e get one lecturer for Engineering wen dey like to set hard hard questions for exams. U know those kind of lecturers wen dey use example for textbook teach, but wen exam reach na the exercise dey go use take set questions. Students dey complain well well about d lecturer. One day, after one exam, the Dean of Engineering come call d Lecturer enter em office. He come give am seat, give am the question paper wen d lecturer use take set d exam, give am biro and paper, set clock to time am, d Dean say, ‘oya, answer your questions in the allocated time.’ Simple thing! Na u set these questions, u na answer d questions? O boy, na so d lecturer dey sweat like who dem pour water for him body. E nor fit answer d questions in d allocated time. Abeg, Mr. Lecturer make who na dey pity students naa, set questions wen your children fit anwer naaa. Biko! Mr. Lecturer Laho (please)!

No comments: