Wednesday 23 January 2013

I Love Pidgin English Talk Talk (3)



Funny thins – Na God Call Me!
This thin dey tire me. You go see people wen dey say na God call dem. Uhmmm! If you be Bank Manager God come call you, you come leave bank work come start your ministry, I go understand o. If u be Chairman of a multinational company, you dey fly with private jet, God come call you, you come leave that work turn to Pastor, I go understand o. Na real sacrifice be that! But the one wen I dey see dey tire man pikin o. You go see graduate wen don serve finish, two years no job, four years no job, on the fifth year, my guy open church for one uncompleted building dey say God call am, na waooo!
E get one man wen open school. School dey function well. After some years life happened and school come fold up. My guy come turn the school to church. E say na God call am. My brother na waooo!
Late Sunny Okosun wen sing sing secular music, wen e see say em music nor dey rain again, e come dey sing gospel music, dey say na God call, na waooo. Politician don dey learn dat thing. Many politicians dey say God call dem to rule, both those wen win and those wen nor win, I nor call person name o. But these people na waooo!
Wetin dey pain be say, must you say, ‘God called me’? Na every body God dey call. Even for Bible how many people God call directly, dem nor many ooo! If you wan do business, do business, if you wan open church, open church, if you wan sing or be politician do wetin dey your mind to do, if you succeed we thank God, if you nor succeed, you try again, must you say, ‘God called me’? Make we nor dey call God name bcos our mouth dey scratch us. Whether na God call dem, I nor know, me I nor dey there o.

No comments: