Thursday 24 January 2013

Jokes in Pidgin English (22) – Strong Man!



Those days we dey hear say the best way to defend is to attack. My brother these days, according to one of my friends, the best way to defend is to run o. Nowadays the best defenders na those wen sabi run pass. Those days I dey see people wen say dem stubborn, dem go smoke 'igbor' (Indian hemp) come dey say, 'You know who I be? Nor try me o'. Nowadays e get some things wen you go see, you go loyal! If you like smoke all the 'igbor' wen dey this world, wen you see or hear about d Bigger Brosses, you must loyal na. E get one guy, wen e don smoke finish, e go dey intimidate everybody. Na so one day, the guy smoke finish, e come dey waka for road, dey curse anybody wen e see. Na so the guy come jam some guys wen dey throwaway things, 'kpo kpo kpo kpa kpa kpa gbooor gboor.' My brother, wetin dis guy see, the 'igbor' clear comot from em eyes sharp sharp. E ma come pick race dey run. People dey ask am, 'Strong man, why u dey run? Wetin happen?' The guy dey run, e nor stop. Wen e run reach one place, e don tire, so e come stop. People come ask am, 'Strong man, we think say u nor dey fear anything. Wetin make u dey run?' The guy dey try breathe, 'eh… eh… eh…' to recover from d race. Finally, e say, ' Abeg I nor be strong man o, people wen get the world dem dey road o'. My guy continue the race. E see wetin  pass am.

No comments: