Thursday 10 January 2013

Jokes in Pidgin English (8) - Police too na human being!


Years ago, e get one policeman wen dey guard one bank. If you see dis man wit 

em gun in front of d bank, u go think say 'no shaking,' 'nothin dey happen' like 

2face. One day something happen oh. The policeman just dey relax 4 one shop 

near d bank, na em some guys show wit automatic pump action: 

'kpakpakpakpa kpukpukpukpu gborgborgbor.' Before u say Jack, d policeman 

run hide under one woman wrapper, 'cover me, cover me.' I nor blame d guy 

because police too na human being!




U know say if armed robbers dey rob somewhere and u call police, dem go 

delay, wait for sometime. When dem reason say d robbers don go, dem go show 

wit their 1960's guns, 'Where dem? Where d robbers?' As if, if dem meet d 

robbers, na die. E come get one day, police hear say robbers dey rob 

somewhere. Dem come delay. When dem calculate d time wen d robbers 

suppose don comot, dem come enter motor drive to d area. As dem reach d 

area, dem hear gunshots 'kpakpakpakpukpu,' na so d police make sharp U-

turn, 'dem still dey, dem still dey.' Na so dem run from d scene. Nor blame dem. 

Police too na human being!

No comments: